Since morning I never chop
I don try sotaaaay I tire
Even the chinchiri birds no drop
As my catapult dey spit fire
Dem just dey follow me sing
Wetin man go do?
Abi make I follow dem dey sing?
Where again person go go?
Chai! …and na only me waka come!